This morning i read 4 paper say oga VP don blast one guy so wey be Acting Director alias senior house boy of Nigerian Institute of Policy and Strategic Studies.(NIPSS) Dr.Yakubu Sankey.
VP talk 4 oyibo say Dr.Sankey b "a man not to be trusted with the sober demands of high office" ukpabiaeh!
Wetin cos dis katakata na as Dr.Sankey take go 4newspaper talk say VP been sabotage d autonomy of NIPSS. Egbudu!
The tori be say i get one man, Mr.Brigss way be Assistant director(that is junior house boy) for dat NIPSS too. Dr.Sankey and one administrative panel been don suspend Brigss sake of say they talk say im thief another man camera wen they been go training tour for China. Na wah o!
But as the tori reach VP ear im come talk say make they cancel the suspension and return 2status quo ante. Oyibo!
For the same statement way VP use blast Dr.Sankey, VP talk say as na only court fit talk weda or wedan't Mr. Brigss thief the camera true true, Dr. Sankey and im kwekwe administrative panel been act ultra vires...